Home
Categories
EXPLORE
True Crime
Comedy
Society & Culture
Business
News
Sports
TV & Film
About Us
Contact Us
Copyright
© 2024 PodJoint
Podjoint Logo
US
00:00 / 00:00
Sign in

or

Don't have an account?
Sign up
Forgot password
https://is1-ssl.mzstatic.com/image/thumb/Podcasts211/v4/0f/1e/1b/0f1e1bf3-ac38-fba0-9b86-90bd75ec181c/mza_7743930111605487756.jpg/600x600bb.jpg
Pidgin Vibez
Pidgin Vibez
45 episodes
16 hours ago
Welcome to Pidgin Vibez Podcast! We dey bring you unfiltered, evriday conversations from all corners of life. Whether na trending gist, real life experience, funny stories, or normal evri day wahala, we dey tok am all. No script, just real tok for pipo wey wan hear di gist as e be. Tune in for fresh yarnings and join our community as we explore different topics, laugh, and reflect. No forget to hit follow, so you neva miss any episode of di vibez!
Show more...
News
RSS
All content for Pidgin Vibez is the property of Pidgin Vibez and is served directly from their servers with no modification, redirects, or rehosting. The podcast is not affiliated with or endorsed by Podjoint in any way.
Welcome to Pidgin Vibez Podcast! We dey bring you unfiltered, evriday conversations from all corners of life. Whether na trending gist, real life experience, funny stories, or normal evri day wahala, we dey tok am all. No script, just real tok for pipo wey wan hear di gist as e be. Tune in for fresh yarnings and join our community as we explore different topics, laugh, and reflect. No forget to hit follow, so you neva miss any episode of di vibez!
Show more...
News
Episodes (20/45)
Pidgin Vibez
Work Don Hot! Flyover Bridge Dey Rise for Ramat Park for Benin City

My pipo, work don really choke for Ramat Park Flyover Bridge inside Benin City o.
Dis bridge project na one of di biggest wey dey happen for Edo State right now, evri wia don full wit caterpillar, concrete and heavy machine wey dey reshape di whole area.

No forget to like, share & subscribe for more Benin City updates, Naija construction gist, and Edo State development.

Show more...
17 hours ago
3 minutes 12 seconds

Pidgin Vibez
Arsenal Don Climb Top Again🔥

Arsenal don show say dem no dey play dis season.
Gunners don waka go top of di Premier League table afta anoda mad performance wey scatter evri wia.
Arteta boys dey on fire, but you think say dem fit hold dis top till end of season?
No forget to like, drop comment, and subscribe make you no miss any Arsenal gist again.

Show more...
1 week ago
5 minutes 21 seconds

Pidgin Vibez
OBA Market Renovation for Benin City - See as di Place Don Turn!

My pipo, dis na di real update on OBA Market renovation for Benin City.

We waka reach di market ground to see how far work don go, how e dey affect traders, plus wetin dey sup for di area now. You go shock wen you see di current state.

If you dey from Benin City or you sabi Edo vibez, you go feel dis one wella. No forget to like, drop your comment, and subscribe make you no miss any Benin or Edo State update as e dey hot.

Drop your thought for comment, dis renovation go help traders or e go stress dem more?


Show more...
1 week ago
2 minutes 42 seconds

Pidgin Vibez
CAF Reject Naija Refs Again 😳

CAF don shock Nigerians again as dem reject Naija referees for anoda major African football tournament!.
Why CAF no dey trust Nigerian refs? Na bias, politics, or poor performance?

Make sure you like, drop your take for comment, and subscribe so you no miss any fresh football gist wey go drop next.

Show more...
1 week ago
3 minutes 36 seconds

Pidgin Vibez
Naija Safe Like Dis?

Naija na one of di most lively kontri for Africa, but di big wahala be, Naija really safe like dis for 2025?

Di way our young pipo dey find moni dis days dem dey do evri tin and anytin for di moni to come.

Di yarnings na about wetin no good wey come be normal for our surroundings.

Abeg no forget to like, drop comment, and subscribe.


Show more...
1 month ago
4 minutes 3 seconds

Pidgin Vibez
Arsenal Shock Man United 1-0 for Old Trafford | Premier League 2025/26 Opener ⚽

Na wahala opener be dis one o! Arsenal don knack Manchester United 1-0 for Old Trafford as Premier League 2025/26 season start.

Di match choke, Gunners show strong defence, sharp ball play and dem still run United down for dia own home.
Arteta boys carry 3 points waka comot Old Trafford, Red Devils fans shock scatter.


No forget to like 👍, drop your comment 💬 and subscribe 🔔 for more Premier League gist, and football mata.

Show more...
2 months ago
3 minutes 25 seconds

Pidgin Vibez
Why Married Women Dey Cheat Anyhow for Naija | Wetin Really Dey Happen?

Wetin dey make plenty married women for Naija dey cheat on top dis husband?

We unpack all di real gist wey dey cause infidelity for Nigerian marriage today.

Na time to ask, Na who fault am? Men or women? Or na society wey don spoil?


No dull, like, drop your comment, and subscribe to catch more hot gist about Naija lifestyle, relationship gbege, and society mata.

Show more...
3 months ago
4 minutes 23 seconds

Pidgin Vibez
Gym Don Turn Runway? Babes Dey Show Skin Like Say Na Fashion Show

Na wah oh! Dis gym no be normal again babes dey pull up wit outfits wey go make you shout “Jesu!

From crazy crop tops to tight leggings wey leave notin to imagination, di gym don turn mini runway.

Wetin really dey happen? Na confidence or clout chasing?

Listen, drop your hot take for comment, and make sure you LIKE, SUBSCRIBE, and ON BELL 🔔 for more crazy gym trends, fashion wahala, and lifestyle gist.

Show more...
3 months ago
4 minutes 8 seconds

Pidgin Vibez
Naija Rain Wahala No Be Here | You Gats Know Wetin Happen

Omo! Once rain start for Naija like dis, na gbas gbos full evri wia.

We go yarn wetin we dey face anytime rainy season land and wetin we go gat do to see play safe.

Whether you dey Benin, Lagos, PH, or anywia for Naija, you go relate sharp-sharp.

Na real-life Naija rainy season wahala we package for here o.
Make you listen till di end, laugh small, and if e touch you LIKE, COMMENT & SUBSCRIBE sharp-sharp.

No forget to drop your own rain gist for comment section. We dey wait.

Show more...
3 months ago
4 minutes 11 seconds

Pidgin Vibez
Dis FIFA Club World Cup Mata - E Really Worth Am?

Abeg make we tok true, dis FIFA Club World Cup wey FIFA dey always hype, e really make sense? Abi na just anoda jamboree wey no get beta impact?

Na European clubs dey win am evri time, fans no dey too show, and di whole tin dey feel like say na moni runs.

Di players dey play too much games, but clubs need di moni.

Na real football tok we dey do here.
💬 Drop your take for comment.
🔔 No forget to like, sub and knock dat bell, e go help di mata.

Show more...
3 months ago
3 minutes 58 seconds

Pidgin Vibez
DENGUE FEVER DON LAND FOR EDO STATE

Dengue Fever don show face for Edo State and e no dey smile at all. Pipo dey sick, hospital don full, and fear dey evri wia.

For dis video, we go run am as signs wey you go see, and how you fit take protect yourself and your pipo.

Na mosquito dey carry di Dengue Fever, no dull o!

If you dey Benin or anywia for Edo, dis gist na for you.

📢 Make you watch am sharp-sharp and share give your people. E fit save life o!

👍🏽 Like, drop comment, and subscribe if you dey feel di vibez, updates full ground!

Show more...
3 months ago
3 minutes 53 seconds

Pidgin Vibez
ADC Coalition: Na Setup Abi Na Blessing?

Wetin be dis ADC Coalition wey evri bodi dey tok about?

Na beta plan for di future of Nigeria politics or just anoda political waka-pass?

Join di conversation drop your thoughts for comment section

Make sure you like, subscribe & tap dat bell so you no go miss any gist.

Show more...
4 months ago
4 minutes 4 seconds

Pidgin Vibez
Wetin Dey Worry Arteta? E Don Go Collect Anoda Chelsea Player

My pipo, Arteta no wan rest oh! Afta all di Chelsea players wey e don eye, e don dey drag Noni Madueke now join Arsenal wahala.

Na wetin dey really sup? Dis video go break down why Arsenal dey rush Chelsea boys like say na Black Friday sale.

Drop your mind for comment section.

You reason say Madueke go deliver for Arsenal or Arteta just dey craze for Chelsea players?

Abeg no dull, Like, Comment, and Subscribe for beta football gist and transfer tori.

Show more...
4 months ago
3 minutes 54 seconds

Pidgin Vibez
2Baba Apology: Wetin Really Dey Happen?

Omo! Afta dat podcast wey 2Baba do wit Nedu, baba drop one apology video wey dey confuse evri bodi.
Wetin make am dey apologize?

Who dey record am?

Pipo don begin tok say baba attitude and im doings no clear, and social media don scatter wit reaction.

No dull, drop your opinion for comment, like di video, and make you subscribe for more Naija celeb gist!


Show more...
4 months ago
4 minutes 38 seconds

Pidgin Vibez
E Don Happen! Kepa Don Sign for Arsenal | Arteta No Send Anybodi

Omo, e don set!

Kepa Arrizabalaga don waka enta Arsenal camp gbagam

Mikel Arteta no dey play at all dis one na serious gbos gbos for Premier League o.

No dull!

Abeg LIKE, DROP COMMENT, SUBSCRIBE and tell us if dis move make sense or e be wahala.
Make we reason am togeda

Who go chop bench now? Kepa or Raya?

Drop your take below 👇🏾


Show more...
4 months ago
3 minutes 6 seconds

Pidgin Vibez
Wizkid Don Cancel Tour?! Wetin Really Happen Go Shock You

Omo e don happen! Wizkid don shock evribodi as e cancel im tour just like dat .

Na health wahala? Low ticket sales? Or dem dey hide sometin for back?

Make una no reason am alone , for dis episode, we go run full gist wey dey street and wetin fans dey yarn.

Starboy no show face again , see wetin go really make am cancel dis tour. Na full breakdown be dis!

Abeg no dull! Like, drop comment, subscribe and tap bell make you no miss any latest Naija entertainment gist.

👇 You shock? Drop your mind for comment section.

Show more...
5 months ago
4 minutes 14 seconds

Pidgin Vibez
Public Bus Safe Like Dat? Wetin Dey Happen Inside Go Shock You

You dey enta public bus steady? You go wan listen first!

We run street check on wetin dey really happen for inside public bus, from small gbege to serious wahala wey fit happen anytime.

We tok true tok about how to shine eye, stay safe and no carry last inside any public bus. .

Whether na daily hustle or one-time waka, dis yarning go open your eye.

🔔 Abeg like, drop your take for comment, and subscribe if you dey feel am.
👉 Tag your guy wey dey always enta bus, e go tank you lata.

Show more...
6 months ago
5 minutes 6 seconds

Pidgin Vibez
EFCC Don Carry Persin Again! Wahala For Naira Spraying

Gbege don shele again o! EFCC don knack arrest on top say persIn dey spray naira for party like say na tissue.

For dis episode, we go run you di full mata, how e take happen, wetin EFCC yarn, and di kind wahala wey dey wait anybod. wey still dey plan do am.

You wan flex? Beta shine your eye.

EFCC no dey smile again!


Abeg LIKE, DROP COMMENT & SUBSCRIBE sharp-sharp for more beta gist wey dey hot for Naija.

You feel say EFCC dey do too much or dem dey try set example?

Tok your mind for comment.

Show more...
6 months ago
5 minutes 22 seconds

Pidgin Vibez
Mama & Papa, See Why You Must Visit Your Pikin for Skul Witout Notice!

Mama & Papa, you sure say you sabi wetin your pikin dey do for skul? 🎓🤔 Some students get double life, one for house, anoda one for skul! If you no waka go check dem witoutnotice, you fit open eye see tins wey go shock you! 😨

For dis episode, we go yarn:
✔ Why e important to surprise yourpikin for skul 👀
✔ Shocking tins wey parents dondiscover 😱
✔ How e go help your pikin stay focusedand responsible
✔ Best way to balance trust andmonitoring 📖

No wait make dem tell you story, waka go see am yourself! 📢 LIKE 👍, COMMENT 💬 wetin you think, and SUBSCRIBE 🔔 for more family and lifestyle gist!

Show more...
8 months ago
7 minutes

Pidgin Vibez
UEFA Champions League Round of 16 Draw

Omo! UEFA Champions League Round of 16 Draw don land, and e choke! 😲 See as big teams dey jam dem selves for knockout stage.

Who go qualify? Who go shock evri bodi? We go break down all di matchups, analyze di key battles, and drop our predictions!

📢 No forget to LIKE👍, COMMENT 💬 your predictions, and SUBSCRIBE 🔔 make you no miss any UEFA Champions League gist!

Show more...
8 months ago
8 minutes 18 seconds

Pidgin Vibez
Welcome to Pidgin Vibez Podcast! We dey bring you unfiltered, evriday conversations from all corners of life. Whether na trending gist, real life experience, funny stories, or normal evri day wahala, we dey tok am all. No script, just real tok for pipo wey wan hear di gist as e be. Tune in for fresh yarnings and join our community as we explore different topics, laugh, and reflect. No forget to hit follow, so you neva miss any episode of di vibez!