
On top wetin dey happen, we dey chuck mouth for the mata wey concern DNA on top Paternity fraud mata. We hear say one lady born twins with different papa after she sleep wit de two different papa the same day. Nai we say as de mata don enter did level, e fit be say plenty women nor even fit know de real papa of dem pikin bcos we also hear say some girls, wen dem wan marry, dem dey do farewell kerewa wit deir former bobo, and desame time, dem dey do wit de husband wey dem wan marry. Wen bele come, dem go say na man wey dem marry, but e possible say if dem do DNA test, na de bobo go get de pikin. For dis kind mata, we ask say dem suppose dey do DNA test for new born pikin? For Everyday Tori today, una go follow us chuck for dis tori wey don tie wrapper for our obodo Naija. For our trending stories segment, we go chuck mouth for BBNaija live eviction yesterday and plenty oda tori wey full ground. Make una carry chair sit down. Make una follow us for our social media handles: Search @LeadershipNGA for YouTube, Facebook and Twitter