
Everyday Tori: As People Wey Get Beta Handiwork Dey Follow Steal, Wetin Dem Sey Mek Others Do? As People Wey Get Beta Handiwork Dey Follow Steal, Wetin Dem Sey Mek Others Do? On top wetin dey happen, we dey chuck mouth for the mata wey concern us today Friday. We hear for Tori sey operatives of the Edo State Police Command don arrest one medical doctor, Abbas Adeyemi Adebowale, wey kpai one cab driver, Emnanuel Agbovinuere, 39, and thief e moto. The Edo State Police Command wey parade di 36 year old Kwara State based medical doctor from Offa Local Government Area of Kwara State, sey di doctor administer sniper for the cab driver tek kpai am. Di tori come bi like one of King Ahab for Bible wey kill one poor man, Naboth for one small land wey e inherit from e family. We nor know wetin to call dis one; na greed abi na wetin? Dis na pesin wey bi medical doctor and e dey work for hospital o and e get opportunity to tek buy e own but na di one wey anoda man get, dey e eye. On top of de wahala for dis our Naija, na situation like dis come dey add fuel wey nor mek our kontri beta. We see our graduates wey get opportunity tek beta for life, dey cut corners. Dem nor wan wait sam sam for their turn as dem dey in hurry to mek am. Na e dey bring di yama yama tins we dey see for our society now. Dem dey join yahoo yahoo, join cult, kill papa, mama, girlfriend sek of sey dem wan belong. For Everyday Tori today, we dey ask sey how you go tek judge dis mata? Una go join us reason de way out of dis mata wey tie plenti wrapper. Make una follow us for our social media handles: Search @LeadershipNGA for YouTube, Facebook and Twitter